Image Image Image Image Image Image Image Image Image Image

KonkNaija Media | May 4, 2016

Scroll to top

Top

Tori toto olopa don detain malu inside kwaikwai case o

Tori toto olopa don detain malu inside kwaikwai case o

Tori For Town: Police for inside Sango Ota, Ogun State bin arrest one cow afta the kpaing of the 24years old man wey im name nah Azeez Salako for inside Ilate area of Ota for Ogun State.

News people yarn say nah as the youths of Ilata Ota bin dewy plan dem carnival on Saturday 27 April, 2013, naim some of the youths just begin get argument wey lead to fight, wey one of the youths wey dey dere, Dayo bin just burst bottle take chook Salako for neck wey nah from dere e take bleed kpai.

When police bin reach where the badness bin happen nah only the cow wey the youths bin wan use do the carnival dem bin see & as dem nor see any other person naim dem kukuma arrest the cow go dem station.

When news people bin go Sango Area Command wey nah dere dem report the matter, naim dem talk say both the Area Commander ACP Titi Kayode & the Divisional Police Officer (DPO) in charge of Sango Division, CSP Dibie bin nor dey ground to answer the newspeople, but as e be now, dem neva arrest anoda person join the cow wey dem bin arrest before…

Konknaija dey ask wich kain eye u take see dis mata? Abi the cow don turn eye witness?